AUNTY PEACE EPISODE 7 written by Nnenne uju izuanabgara.
AUNTY PEACE
EPISODE 7
written by Nnenne uju izuanabgara.
IYAWO came to spend time with aunty peace.
----IYAWO! IYAWO, na you get two big phones? you dey enjoy o.
-- Good afternoon ma Iyawo greeted smiling. Noo, SHE REPLIED, My husband owns the second phone.
---Okkk, e dey house?
---Noo, he has gone to work. Each time he has alot of work, he gives me his phone. He says he doesn't want to be distracted.
----Hahahaha. AUNTY PEACE LAUGHED.New wife mumu don start.
----(IYAWO WAS suprised) argh! argh!!. Aunty how do you mean?
----How you won call am ask am where e dey? how you won take know wetin e dey do? iyawo wise up. E don carry phone give you, make e be say e no dey hide anything from you. Emmm, wetin dem dey call am ooo, ehen, transparent. Iyawo forget that thing, shine your eye. You see men? Dem be snake o. See, you need to follow them bomber to bomber, no give am space o. you must know where e dey, wetin e dey do and who e dey with. You know say your husband na fine bobo. IYAWO, no dey inside water meh soap enter your eyes o.
---Hmmm,IYAWO SIGHED. Thank you ma but i know my husband. God blessed me with the best man in the world. Aunty, there is nothing he doesn't tell me. I trust my husband and i belive in him so much. Nobody can seperate us o.
----Hahahaha na so ah dey take my own husband brag, where e dey today? IYAWO the earlier the better. protect your territory o.
---Thanks aunty. please give me hundred Naira orange.
AUNTY PEACE made another set of very crazy friends who are also her room mates too. BLACKY and SANDRA. Blacky is a runs girl and deals on weed and hot drinks. SANDRA can go to babalawo for africa. She just enjoys snatching people's husbands. She is already eyeing IYAWO'S HUSBAND.
AT HOME, SANDRA STARTED A CONVERSATION .
--Chai, dah guy set. The boo make sence. E just dey totori my body.
---HA!! BLACKY REPLIED, Sandy baby, na craze don dey come o. abeg leave dah babe meh she enjoy her husband small. wicked geh (laughter)
---Abeg abeg,AUNTY PEACE INTERRUPTED, commot your eye for that guy body. Na my game be that.
IYAWO was heading to the market. She went through aunty peace's place.
AUNTY PEACE CALLED HER.
---Iyawo, where you dey go ooo. you dey go party? mah follow you?
---(IYAWO SMILED) noo, i'm going to the market. Good afternoon ma.
----Hmmm, na market you where 30k clothe dey go?
--Haba, Aunty, 30k kwa? how do you know it's 30k.
---Ah get am before na. even the time wey ah buy am na 50k. Ah go market see am, price am, dem say na 30k last. Iyawo iyawo, dey enjoy abeg ,na your time,OUR OWN GO SOON COME OOOO. no be you buy the cloth? this one you no know the price.
---Noooo. hmmm, me buy clothes? i don't buy o. My husband does all my shopping including panties and bra o.
Even the weavon on my hair, make-up, everything, my husband buys them.
---Hmm nawa o, AUNTY PEACE REPLIED. The man dey nice o but, shey e dey give you money sha?
-----hmmm, AUNTY, he doesn't o. and what do i need the money for, since he provides all my needs even up to sanitary pads and i'm working too.
------Iyawo, no be like that. make e give you the money so you go use your hand go buy wetin you want. ok, see this clothe wey you wear now, you no know the value because you no know the price and i sure say if na you go market, you no go buy one clothe 30k. Iyawo men wicked o. Now wey e never spoil, gather enough o. Raining season go soon come o. if e dey give you, dey put am for your account. No trust any man o.
---Aunty, my husband is not like that o and besides, we run joint account. i know how much my husband has, and he knows mine too.
----Iyawo go market and goan buy sense o. how you get joint account with your husband. hmm, the time wey e go shele, no say AUNTY PEACE no warn you o
---(IYAWO LAUGHED) My one and only aunty, i know you have my interest at heart and i also know you mean well for me but trust me, nothing will happen. This lady you're seeing here have really suffered in life o. God promised to comfort me through marriage.Aunty do you know, my husband buys food stuff himself. inshort, i just thank God. it is good to be a child of God o. God will always fight for you.
AUNTY PEACE----hmmm, i hear you. oya dey go your market. iyawo cash (laughter) just dey bring for me too o. me too i like better thing.
----Alright aunty. later.
At night the trio (AUNTY PEACE, SANDRA AND BLACKY) started their gossip again.
----Ehen, peace, how far na. you and your boo, e don connect? hahahaha
----Una no well BLACKY repiled. Plenty single bobo dey everywhere, make una leave person husband oooo
-----Sharrap dia, AUNTY PEACE FIRED BACK.your name na peace?(To sandra)babes ehee,if you see the kain cloth wey dah geh wear dey go market, market o, 30k clothe. if you see wetin dat guy dey do for eim wife, e over too much. e go just spoil that girl. Babes, as he be now ehee, ah no sure say ah fit enter them o. E be like say that iyawo sabi pray well well. chai, that guy dey sweet me ooo. My body just dey do me miri-miri. chai oooo. ah must get am. ah must get that guy.
S---Babe do quick. if ah wait you no do anything, ah go chance you o. hahahahahaha. me sef na ant, i like sugar die. (Sandra laughed)
---E be like say you go carry me go that your baba place o, Aunty peace replied.
---HIAN, wait o, peace, you serious for this guy o. you sef wan dey go babalawo? because of person husband? hahahaha. nawa o, wetin we go call this one now? BLACKY ASKED.
---Abeg mind your ogogoro o. no just put your mouth for my matter again. which one be your own? AUNTY PEACE REPLIED.
----babe, SANDRA CALLED AUNTY PEACE. Abeg live that geh. See, make we first use brain. if brain no work then we go meet baba. ah get plan. THE plan go need new sim o. you go buy new sim.
----Kai, i trust you babe. abeg chop obama high five. sim no be problem. anything weh you want, ah go give you. just arrange am as e go be.
AUNTY PEACE visited iyawo that day.
Chaaiiiii...at last oooo. my aunty has come to visit me ooo. IYAWO SAID REJOICING.
WOMEN, let us be careful!
TO BE CONTINUED.
Comments